Man gives Super Eagles striker Victor Osimhen 24-hour ultimatum to return ₦3 billion house, invest money to help poor Nigerians.

“Osimhen, so you get mind, go buy house of 3 billion Naira. Osimhen, you get mind, go buy house of 3 billion Naira. Bro, that’s financial mistake.

You dey get the point, but I give you one day to go and turn that house and hold your money back. Bro, Osimhen, what have we gained from you since you don become a superstar?

Nigerian poor masses, what have we gained from you? Nothing. I no say make you no enjoy your money but sometimes as government no care for us, una wey guide, wey get money, dey show love sometimes to the poor masses.

I never see anything wey Nigerians gain from you Osimhen. So you get that kind of money, you buy house of 3 billion Naira for Lekki.
You no see house 100 million buy or 50 million buy, you get a house of 3 billion Naira. Bro, that’s mistake.

If dey feel me, OBO, how much house him dey live? The richest musician, like how much house him dey live? Go and turn that house, come and build something for Nigeria.

Build factories and employ workers. Government no dey care, una wey get money dey show love. I saw you when Carter Efe dey ask you, Nigerian football and musician who dey chop money pass, you dey mention say na football.

Ok, what have we gain from you Osimhen? Wetin you fit now, wey say, Nigeria poor masses gain from you, nothing. Una should learn from Burna Boy. That boy is trying a lot.

Bro, go and turn that house and collect your money back. You go see house of 15 million or 75 million, buy. Use the money, come and invest in your country and employ workers. That’s how you can develop your country.

There is no Nigerian person wey go talk say him dey proud of you. Bro, come and help people. Help your people. But the w*rst part be say, if you go him village now, like, e fit be one kind bush like that ooh.

Like Burna Boy now, I no believe say, Burna Boy go get that kind of feeling. Dey go just dey come and dey buy, buy, dey buy, everything when you to go their village, bro, they no see food shop for there, bro.

No development. Osimhen, I dey pray for you always. I bęg, go and return that house as of 3 billion naira for waiting, for waiting, bro, as of 3 billion naira. That’s big financial mistake, my man.”

— Man gives Super Eagles striker Victor Osimhen 24-hour ultimatum to return ₦3 billion house, invest money to help poor Nigerians.

CATEGORIES
Share This

COMMENTS

Wordpress (0)
Disqus ( )